Album Cover Delete

Delete

Erigga

4

Bottles up! put dem in the air

Men dey talk, I know wetin I hear

Live my life, like ion really careCos when e burst

When he burst (p_p_ple)

W-w-when e burst

When e burst

When e burst, people dey delete

Men go stab your back ask you why you dey bleed

Their plan na to bury me but Erigga na seed

Iffa dey yan my mind dem go say na weed

So I keep my ish to myself, I don see am no need

Cos at the end men go do wetin sweet dem

But karma know their address charter keke meet dem

Your man go hide stain your clothes becos he dey sell bleach

To quensh you nor go hard am like benson swish

Weda you play your piano or dey into music

Make your money leave poor man with excuses

The way my circle take small like okro muni

Na beta pass, snake dere nor fit wound me

I nor fit use my two legs test weda river deep

Reduce the hennesy, iffa hear say liver cheap

King of the South, nor dey binu for my leadership

Enjoy the voyage, just take am say na symbal ship

Bottles up! put dem in the air

Men dey talk, I nor wetin i hear

Live my life, like ion really care

Cos when e burst, people dey delete (people dae delete)

When he burst, people dey delete (people dae delete)

When e burst, people dey delete (people dae delete)

When e burst, people dey delete (people dae delete)

When e burst (people dey del-)

I just wan stay fresh like brand new shimmy

Play with my money, burst your head with full remy

Nothing you wan tell me

About this street my guy

Once you broke men men dey dismiss my guy

Before my coffin drop, order one casket come

Don P If benson dey bring like two packets come

Stand untop of the clubhouse, girls dey go insane

We dey come this life finish, na to go remain

Three girls for my bed, two dey crush my rod

Half bottle of hennesy follow my come from club

One boyfriend dey call she save he name with love

But she prefer to dey with me cos money dey involve

Na mula dey rule the world, oko leave mathset

My brother say na love, tha one na e mindset

He bae dey cheat anyhow like baby wey dey purge

He name nor be finidi so leave am make e deu judge

Gen still dey on, AC still dey blow

NEPA still dey knock, be like say men dey owe

By pass the meter, Segun from Ejeba hood

Forget this Lekki life, this Erigga you self you nor good

Bottles up! put dem in the air

Men dey talk, I know wetin I hear

Live my life, like ion really care

Cos when e burst, people dey delete (people dae delete)

When e burst, people dey delete (people dae delete)

When e burst, people dey delete (people dae delete)

When e burst, people dey delete (people dae delete)

When e burst (my brothers dey del-)

Lagu lain oleh Erigga